UN BBC Pidgin Articles General - bix nood cof bin

  • Want to keep track of this thread?
    Accounts can bookmark posts, watch threads for updates, and jump back to where you stopped reading.
    Create account
https://www.bbc.com/pidgin/world-42551917

E don reach six days of fight-fight for Iran wey more than 20 people don die and plenty sef don injure.

Across di whole country, many people, especially young men, don enter street to complain say things hard - no job, no money and in short make dia leader - Hassan Rouhani - comot from office.

Di government bin talk say people get right to protest in peace, but plenty of di protest don dey violent.

Video wey some people don post for social media don show police dey fight with people for street and some dey show people dey attack public buildings.

Since Saturday wey all di protest start, dem don arrest pass 400 people for Tehran, di capital. Na di semiofficial news agency ILNA carry dis one and na from di political security deputy for Tehran governor office mouth, Ali Asghar Naserbakht dem collect dis tori.

On 2 January di supreme leader for Iran, Ayatollah Ali Khamenei tell di world say na "enemies" dey cause all di palava.

Khamenei enter im website to write say: "As day just dey go, enemies of Iran dey use many things like money, gun, politics and corner-corner to arrange wahala for di Islamic Republic."

But who be di enemies? Im no call anybody name.

Some people wey dey look di situation talk say na style wey di leader dey use talk say di enemy dem get na Saudi Arabia, US and Israel.

And e be like dia head fit dey dia.

US President Donal Trump don already use Twitter to talk im own.

Image Copyright @realDonaldTrump@REALDONALDTRUMP
As di people dey continue di protest for Iran, people for world dey look as di thing dey go because fight-fight for Middle East get as e be.

Different country dem wey don see dis kain thing fit get better or things go bad pass.

Saudi Arabia don accuse Iran say dem get hand for fight-fight wey don affect countries like Yemen and Syria.

But US ambassador for United Nations, Nikki Haley, talk say di protest dem start just like dat. She say US wan arrange emergency UN meeting.

Protest like dis don happen before?
Yes.

Na 2009 Iran see dis kain protest but e only happen for Tehran, di capital.

Dat time dem call di protest "Green Movement" and dem do am say dem no support when di president of dat time, Mahmoud Ahmadinejad, win election.
 
What New Hampshire born whiter-than-sour-cream intersectional basket weaving major got hired to write this crap?
 
Bleach, lizard poo and oda dangerous tins pipo dey use to get high

Dry pawpaw, plantain or cassava leaf, di white part of lizard poo and even dry human poo, bleach inside soft drink, spirogyra, burnt tyres and 10 days urine na some of di tins wey pipo dey use to get high.

Tok-tok pesin for National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) for River State, Emmanuel Ogbumgbada say as dem dey do dia work, dem don discover dis yeye ways pipo dey take get high. Im describe am as non-conventional drugs because dem no dey di list of United Nations banned substances and controlled drugs.

Most of di attention for Nigeria dey on pipo wey dey abuse cough syrup wey get codeine and anoda medicine wey dem call Tramadol. But according to NDLEA, some of dis oda unusual tins also dey very dangerous to health.

Oga Ogbumgbada say health-wise, research still dey go on to find out how those tins fit destroy human being body but di major tin be say addiction dey and dat one dey give brain problem and na wahala to society as dem go live rough life and be danger to evribodi.

Im say dem don treat pipo wey dey abuse dis kain tins and say wen dem test some of dem, notin dey show for dia test kit.

"E get one of dem, wen we calm down come ask am, e come say na dry cassava leaf e take wey make an high. But afta counsel and treatment, im don improve."

Di NDLEA oga come advice youth to dey careful say even though adolescent age na time to try new tins, say make dem stay out of drugs as e dey destroy life.

For di past three years di emphasis for World Anti-drug day na 'Listen First' and na for parents to listen and watch dia pikin so dat anytime dem begin notice any behaviour wey dey one kain, dem fit trace wia di wahala dey come from.

https://www.bbc.com/pidgin/tori-44144027
https://archive.is/rS0gR
 
President Buhari don finally tok about weda im be clone

https://www.bbc.com/pidgin/media-46421191

Nigeria President Muhammadu Buhari don finally react to rumour and tori wey don dey fly upadan say im be 'clone'.

Di president wey dey Poland for di 24th session of di Conference of di Parties (COP24) under di UN Framework Convention on Climate Change (UNFCCC), address di rumour wen im dey tok to Nigerians.

Im say some pipo bin wish make im die, wen im bin dey sick for many months.

"Na di real me… I go soon celebrate my 76th birthday and I still dey strong," im tok.
 
Ressing de thread fo dis

Justice for Uwa: 'Dem rape her, she be virgin, she neva do am before'

Di life of one 22 year-old girl, Uwavera Omozuwa don cut short afta she die on Saturday, May 30 from alleged rape wey happun inside one church for Ikpoba Hill, Edo state, Nigeria.

Tori be say Uwa, wey be first year Microbiology student for University of Benin, bin go read inside one Redeemed Christian Church of God near her house wen di rape happen, according to wetin her elder sister Judith Omozuwa tell BBC Pidgin.

Three days later afta di alleged rape incident, Uwavera die for hospital.

Wetin we know so far

BBC Pidgin reach out to Uwavera elder sister, Judith, wey give us di load down of wetin really happen.

"My sister bin go church for morning to read. She dey always go dia to read even before she gain admission for University because e dey quiet.

Around afta 6pm, my mama receive call from one of di church members say make we come o say dem no know wetin dem do my sister. One of di women wey find my sister say wen dem see her, her skirt and pant don tear and her shirt dey soaked wit blood.

Dem rape her, she be virgin, she neva do am before", Judith narrate wit tears wey full her eyes.

Before Uwavera family members go reach di church, dem tell dem say dem don alredi rush her go hospital. Judith explain say na inside pool of blood di church security man, wey dey only start work by 6pm, see Uwavera.

From wetin Judith explain, nobodi including di security man bin dey di church wen di incident happen.

Uwavera bin dey on oxygen for three days but she no make am out of di hospital.

Di young Uwa bin plan to become Nurse for future but as she bin no fit get di course for University, she decide to read di Microbiology course wey UNIBEN give her.

BBC Pidgin bin try follow her mama and papa tok but Judith say dem still dey in too much shock to say anytin.

Di family no get any idea who dey behind di incident but dem dey demand for security agents to find who do am and punish dem.

How pipo dey react to Uwa rape and death

As e be so, Nigerians don enta social media to para about di mata and demand justice from security agencies.

BBC Pidgin bin try reach di Edo state Commissioner of Police and di state Public Relations Officer but dem neva answer our calls.

Is this actually helpful to Africans? This is easier for them to read than English?
 
Link (Archive)

Cold water dey good for body? See wetin Science tok​

29 August 2021

Pipo get different opinions about drinking of iced cold water.

Some believe say drinking of cold water dey bad for digestion and fit cause mucus build-up.

Odas claim say cold water go make pipo burn more calories and e dey also help wit exercise performance.

So wetin be di truth?​

E dey okay to enjoy one cup of ice-cold water wen weather dey hot?

To cut di long story short—yes.

Enough scientific evidence no dey to claim say ice cold water dey bad for pipo.

And di one major effect of drinking ice cold water na — for hydration.

Why drinking cold water go help wit hydration​

First, e dey important to know say drinking water at any temperature go help di body to dey hydrated.

Hydration na simply di process of refill something or somebody wit water.

To stay hydrated dey important as e go help regulate di body temperature.

Hyration go help di organs to functioning properly, deliver nutrients give di body cells.

And e fit even help to prevent infections, according to Harvard Health.

Cold water dey good for body? Read wetin Science​

Drinking water at any temperature dey help di body wit hydration.

However, drinking cold don dey proven say e dey specifically help to assist rehydration pass normal or warm water.

One study from di International Journal of Clinical and Experimental Medicine review six different male athletes on dis mata.

All of dem consume water for different temperatures.

Dem discover say drinking water at 16 degrees Celsius (~60 degrees Fahrenheit) wit a higher intake of water result to less sweating.

Dis show say e better pas wen dem compare am wit odas.
Di study conclude say cold tap water fit be di ultimate temperature for rehydration purposes, especially for athletes wey dey work out inside heat.

One study from di Human Kinetics Journal discover say 10-minute cold shower afta 20 minutes exercise session fit help wit hydration status.

Plus, a 10 minute cold shower (wey also dey known as "cold water therapy") e dey dey proven to help wit muscle recovery for athletes.

Wit di plenty benefit wey drinking of cold water get, some wellness experts claim say;

Cold water no too dey good for di body but sabi pipo don prove dia theories to dey wrong.

Di myths wey surround cold water consumption​

For ayurvedic medicinal practices, e tok say drinking ice cold water dey bad for di body overall digestion.

E claim say drinking of cold water fit tighten di blood vessels, wey no go allow di body fit take some kain nutrients, vitamins, and food.

Drinking warm water na cultural practice for many, wIA di believe na say warm water go help di digestion process to dey fast.

Plus e dey good for your gut health.

Some hold dis claim to western medicine and point to one study for General Pharmacology from 1983.

Di study bin look at how cold dey affect di blood vessel wall and evaluates blood flow and body temperatures for dogs.

While na true say cold weather fit affect di circulatory system, dis study no focus on how drinking ice cold water fit directly affect di blood vessels.

All in all, as di blood vessels dey play important role for digestion, enough scientific evidence no dey to back di claim say;

Drinking of cold water fit slow down your body digestion rate.
Another common misconception wey dey about drinking ice cold water na say e dey cause mucus build-up.

Dis one come from one 1978 study from CHEST Journal wey measure nasal mucus velocity and nasal airflow resistance.

And e find out say hot liquid dey superior to cold liquids wey e come to managing nasal bodily fluids.

However, e dey important to note dis specific study dey archived for di US National Library of Medicine.

But di study no dey available again for review through CHEST Journal online.

Lastly, one claim dey say drinking cold water can fit make you dey very hungry.

Dis claim start from one 2005 study from di University of Florida.

Di study bin compare di difference wey dey appetite when pipo dey exercise wit cold water versus warm water.

And e conclude say those wey exercise in cold water fit get "exaggerated energy intake following exercise".

Dis fit make dem feel very hungry and allow eat more.

Oda studies don dey wey show say pipo dey hungry well-well for cold season pass oda season.

But dis neva still conclude say drinking of cold water fit lead to increased health.
 
Do people actually read in pidgin? I'd assume that those too retarded to speak proper English are too retarded to read, especially in a language so poorly constructed.
 
I have to say I've had more interesting psychotic episodes than this.
 
Who tge fuck reads Pigdin?
 
Back
Top Bottom